By Ebi Oboko
Barcelona don go beat Real Madrid 3-2 for El Clasico for Spain Super Cup final for Saudi Arabia, ni dem run dis one.
Raphinha shine shine bobo, score two goals for di Catalan side.
Barcelona wey dey top La Liga qualify for di final afta dem hammer Real Betis 5-0 for semifinal.
Real Madrid beat Atletico 2-1 for di second semifinal before dis final.
Last year, Barcelona beat Real 5-2 for same final, wey start dia strong season.