By: Esther Ayoola
Police for Zone 2 Lagos, don do jaki chan for one man wey dem name Israel Onen for Federal High Court over N60 million visa yahoo wey im do.
Onen face four charges wey include conspiracy, fraud, money laundering, and stealing.
Court hear say between 2024 and 2025, Onen joinbodi with some pipo wey sti dey on di run  collect N60 million from one innocent  Ayodele Emmanuel.
Police tuk say Onen go leak Ayo ear, Â pretend say e wan hellep am get Ireland and Schengen visas, an na from dere im an di gang carry di money gbase.
Di sweet tori be say Yahoo Onen dey police custody