Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
Di UN children’s agency, UNICEF, on Tuesday report say over 100 pikin don die for Gaza since October ceasefire.
UNICEF spokesperson, James Elder, tell reporters for UN briefing by video link from Gaza say di dead include 60 boys and 40 girls, mainly from military attacks.
E explain say di attacks happen through air strikes, drone strikes, tank shelling, gunfire, and quadcopters, while small number na from war remnants wey explode.
E add say even though di bombings and shootings don reduce since di ceasefire, survival for Gaza still dey conditional because di violence never stop.
Written by: News Editor 1
Gaza ceasefire violation child deaths Gaza children deaths after ceasefire Gaza humanitarian crisis children Middle East crisis Gaza update UNICEF Gaza child casualties
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025