By: Esther Ayoola
Ghana referee Daniel Laryea don get di big job to control di 2025 Africa Cup of Nations semi-final game between Morocco against Naija.
CAF put for dia website say, di big match go sup today for Prince Moulay Abdellah Stadium for Rabat by 9pm , and Laryea go dey in charge.
Before now, im don only referee one game for group stage when Burkina Faso lose 1-0 to Algeria for Group E.
Now, im don get big chance show di world wetin im fit do by handling di game wey pipo dey call final before di final.