Lagos

Lagos Gorment Explain How Hypertension Dey Kpai Lagosians

todayJanuary 14, 2026 5

Background
share close

By: Esther Ayoola

Nor be small tin oh, Data from Lagos State Ministry of Health dey show say, about six million residents dey live with hypertension, but most of dem no sabi say dem get di sickness.

Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, tuk dis one yesterday for leadership tuk, tuk, wey Lagos State Primary Health Care Board organize with partners like Nigeria Health Watch.

Di mata gather top gornment officials, health administrators and local council leaders to check Lagos primary healthcare system and find how dem go take hellep pipo for di state.

Abayomi warn oh dat pipo wey well for Lagos nor plenty oh. hypertension, diabetes and obesity everywia. 

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app