Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
For AFCON 2025 marras, Super Eagles don turn focus go di third-place match against Egypt afta dem lose 4–2 on penalties to host Morocco for semi-final wey happen Wednesday night.
Na for Casablanca dem land on Thursday afternoon, as Naija prepare to face di Pharaohs of Egypt for bronze medal clash.
As dem reach, team schedule recovery training for 6:30pm to cool body and reset mind afta dem lose to Morocco.
Dem talk say di training go open for media, as Nigerians dey wait sharp-sharp to see how Super Eagles go respond for di AFCON 2025 third-place showdown against Egypt.
Written by: News Editor 1
AFCON 2025 Nigeria news Super Eagles third-place match Super Eagles training updates
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025