south west

Makinde Inaugurate Oyo Oba Council Afta 15 Years

todayJanuary 16, 2026

Background
share close

By: Esther Ayoola

Oyo State Govo, Seyi Makinde, don inaugurate Oyo State Council of Obas and Chiefs afta 15 years, wit Olubadan of Ibadan, Oba Rashidi Ladoja, as di first chairman.

Di event happen for House of Chiefs, Secretariat, Ibadan, but Alaafin of Oyo, Oba Akeem Owoade, no show face for di inauguration.

Govnor Makinde tuk say di chairmanship go dey rotate between Olubadan, Alaafin and Soun of Ogbomoso, say na agreement wey dem reach for meeting wit di three monarchs.

But same Thursday, Alaafin media aide, Bode Durojaye, release statement wey counter di govnor tuk.

According to di Alaafin, no such meeting ever happen between am and di govnor.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app