obodo oyinbo

Trump Promise To Send Soldiers Go Minnesota To Stop Protest

todayJanuary 16, 2026 8

Background
share close

By: Esther Ayoola

US Presido, Donald Trump don cut chain, say e fit use one old law wey dem dey call Insurrection Act to send U.S. military go Minnesota, if state officials no stop di protest wahala for Minneapolis.

Di law fit allow military for inside America to help restore order.

Dis warning dey come as protests heat up afta federal Immigration and Customs Enforcement (ICE) officers shoot people during enforcement operations.

For a social media post dis Friday, Trump say, if Minnesota leaders no stop wetin im call “professional agitators” ,  wey dey attack federal agents, e go invoke di Insurrection Act to quickly end di trouble.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app