DONALD TRUMP

72 Results / Page 1 of 8

Background
https://konfamfm.com/wp-content/uploads/2026/11/Election.jpg

obodo oyinbo

Trump Accept Midterm Election Slap

Omo, US Presido, Donald Trump, dey fill di pressure say hin dey ready to accept di midterm election result, as e be like say, Opposition Democrats dey set to chop both Senate and House of Reps! Hin properly dis mata For one phone call with The New York Times on Tuesday night, and e put di blame for why Republicans lose say no be hin dey di election paper to […]

todayNovember 4, 2026 6

obodo oyinbo

US Presido Trump Promise to Wunjure Iran

Trump say e never do Iran finish, like dis hin dey prepare US military to wunjure dem yangaynaga for ground since Iran nor wan put body for dia peace tok. Say iran get mind go worry di Strait of Hormuz. Say only seven oil tankers naim dem damage, di highest since dis war start between US and Iran.

todayOctober 23, 2026 10

obodo oyinbo

Zelensky Fire Trump, Tell Putin Make Hin Drop Gun For 60 Days

By: Mariam Ajayi Ukrainian Presido, Volodymyr Zelensky don drop hin mouth odour unto how dem go take end di war for Urkain, say US presdio  Donald Trump go tell Russia to  agree  60 days ceasefire. Dis one dey come after Trump cast everywia with hin mouth odoour on Saturday say Ukraine need new president wey go agree peace deal. Zelensky dey respond for  interview with ABC News on Sunday say, […]

todayOctober 12, 2026 15

obodo oyinbo

Trump Promise No Attack For Iran Again Until November 3rd

By: Mariam Ajayi Iran military force don konfamate say dem dey do operation every night inside Strait of Hormuz to catch any ship wey break dia law. Mean wider, President Donald Trump say US for dia on part sef dey tuk with Iran and promise say, dem nor go attack dem before di November 3 midterm election. Already Dis tension don make oil price jump up by four percent, carry […]

todayOctober 9, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Tuk Say Iran War Go End Soon

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don tuk say di war between US and Iran fit end soon. E tuk dis one for a campaign rally for San Antonio, Texas on Wednesday. Trump say Steve Witkoff, wey be US tok tok pesin wen dey follow iran pipo dem tok, dey work on how dem fit stop di war. E say Witkoff dey do well for di tuk Trump also […]

todayOctober 8, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Take Put Sand Inside Garri Reject Iran Peace Tok

By: Mariam Ajayi Oil price and bond yield jump up again on Monday after Donald Trump reject Iran offer for seven-day ceasefire. Tehran bin bring plan for UN General Assembly say make dem stop fight and open Strait of Hormuz waterway so that global oil supply go dey go wiririwere And like dis oil business owners, petrol buyers dey cry wetin nor gud. Di only tin wey come out from […]

todaySeptember 28, 2026 20

obodo oyinbo

US Strike Kpai 18 People For Iran, As War Tension Rise Again

By: Mariam Ajayi US strike for Iran don kpai 18 pipo and wunjure 108 others, according to Iran Health Minister. Iran organisation wey dey helep pipo for emergency, war, natural disaster and other serious situations. Society say four pipo kpai and 67 others wunjure when one of di attacks hit wedding ceremony near di coast of Strait of Hormuz. Kuwait military also report missile and drone attacks early Thursday, while […]

todaySeptember 25, 2026 16

obodo oyinbo

Iran Oga Dem Dust Dia Shoe, Waka Comot For UNGA

By: Rilwan Agbomeji Iran officials and members of dia delegation don waka comot out of di UN General Assembly, as dem reject US Presido, Donald Trump’s threat to destroy Iran if Tehran no agree deal with Washington. Trump make di threat during im speech for di 81st UN General Assembly for New York, where e defend di US military campaign against Iran and warn say e fit escalate di conflict. […]

todaySeptember 23, 2026 19

obodo oyinbo

Trump Threatens Iran Say Economy Fit Destroy

By: Mariam Ajayi US Presido Donald Trump don warn Iran say if dem no reach agreement with America, e fit  wipe Iran out or make dia economy rot. Trump give di warning during Fox News interview on Sunday, as tension dey rise ahead of United Nations General Assembly for New York dis week. Meanwhider, Iran military don warn say any fresh US attack go bring painful retaliation across Middle East, […]

todaySeptember 21, 2026 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds