By: Esther Ayoola
Omo nor be small heat touch immigration office yesterday, say Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, enter immigration office do surprise, cut chain say why dem dey delay passport office for Gwagwalada, Abuja.
During di visit, di minister check di VIP and children section, question officials why work no start on time, and tuk with applicants wey still dey wait.
According to Minister Tunji Ojo, everything wey dey hapun for di immigration office, delays and extra charged dey unacceptable.