By: Esther Ayoola
Say one Early mor mor fire don destroy one-storey shopping complex, wey dey Ajegunle Boundary, Lagos, wia business pipo dey sell clothes.
No life loss for di fire except for for plenty money, di Lagos State Emergency Management Agency, LASEMA ni dey konfamate dis tori.
LASEMA Permanent Secretary, Olufemi Oke-Osanyintolu, explain say dem receive distress call around 2:40 a.m. and reach di scene by 3:22 a.m., but di building don already burn well, well before dem reach dia.
Oke-Osanyintolu add say di fire spread quick because of di cloth,  and  from dia first check, say na electricity cause di fire.