By: Esther Ayoola
Lagos State Police Commissioner, CP Olohundare Jimoh through di command tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi don sama beta warning to all Aproko pipo for Lagos to stop di spread fake news.
Dis warning follow news comot, afta aproko pipo begin spread rumor say, jaguda boys dey plan bomb two private schools for Ikeja.
Adebisi explain, say Di Human Resources Manager and Chief Security Officer of di schools ni im report di matter come Ikeja Police station.
Di Command tuk tuk reveal, say, after plenty check for di schools, nothing like bomb, an dey warn make aproko stop di bad character of spreading fake news.