By: Esther Ayoola
Naija athletes go camp for Scotland for four-weeks todo jim jim di body before 2026 Commonwealth Games For Glasgow.
National Sports Commission Director-General, Bukola Olopade, ni dey konfamate dis infomate, say dem pick Aberdeen to make things easy and reduce wahala of travel.
E say early arrival go hellep athletes adjust well and sabi how di conditions go be once di competition start.
Team Naija go reach Aberdeen four weeks before di games for training, preparation, and team bonding.