By: Rilwan Agbomeji
Lagos State House of Assembly don clear members of di House say dem no get any hand for alleged order wey talk make dem fire teargas and arrest protesters for di Assembly gate on Wednesday.
No forget say plenti protesters jam di Assembly gate on Wednesday to show say dem nor happy with di demolition wey State Govment do for Makoko area.
Di clarification dey inside statement wey Hon Stephen Ogundipe, Chairman, House Committee on Information, Strategy and Security sign, and dem give news tori pipo.
Ogundipe talk say, Lagos State House of Assembly don notice one publication wey get title ‘Police teargas Makoko anti-demolition protesters at Lagos Assembly, arrest activist Hassan Soweto, others’, wey Ishaya Ibrahim carry, wey full wrong tori, distortion, and claims wey dem never check wey fit mislead people and cause serious wahala.