National

Oluremi Tinubu Call For Peace, Respect Among Nigerians

todayFebruary 2, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Wi First Lady, Oluremi Tinubu say, make wi Nigerians, try to dey respect one another, live in peace, and tanda together do brotherliness, no mata our culture or belief.

She yarn dis one for her message to mark World Hijab Day 2026, as she encourage pipo, make dem build better understanding and tolerance among themselves.

According to di first lady, Nigeria different- tribe doings and religion suppose to be advantage, dat e suppose bring unity, not wahala.

Senator Oluremi press tuks, say na when Nigerians respect each other choices, faith, and identity, di country go get peace and progress, and dat e dey very importankpa for us to respect ourselves.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app