By: Esther Ayoola
Lagos State Waterside Community residents wey dia houses face demolition by Lagos State Gornment don carry dia mata go meet members of di Lagos State House of Assembly, to find solution on di way forward.
Konfam News waka-waka reach di State House of Assembly for Alausa, Ikeja on Tuesday morning by 10am, and dem report say di meeting start few minutes before 11am.
Just before di meeting begin, Konfam News meet with some of di victims, as dem share dia experience on how di demolition scatter dia lives, make some of dem dey sleep outside for more than three months.
According to di victims, di number of communities wey di demolition affect plenty pass wetin pipo bin report earlier.
Another victim still narrate im experience, begging Lagos State Gornment to stop any further demolition, dat di exercise no follow due process of law, and wetin dem dey ask for na justice and proper redress.
Konfam News go bring una more details as soon as di meeting finish.