By: Esther Ayoola
For Katsina and Kwara states, say bandits don kpai kpai more than 30 pipo for different villages on Tuesday.
For Katsina, di Doma community for Tafoki Ward, Faskari Local Government Area, na at least 20 people dem kill.
Dem burn house and motor, make pipo throway leg run for dia life.
Faskari Local Gornment Chairmo, Surajo Aliyu, tuk say na revenge attack and na di worst wey dem don see for di area, dis months.