INSECURITY

21 Results / Page 1 of 3

Background

OBODO NAIJA

VeryDarkMan Accuse Security Operatives Say Dem Be Di ‘Unknown Gunmen’

By: Mariam Ajayi Social media critic, Martins Vincent Otse, wey pipu know as VeryDarkMan, don accuse Nigerian security operatives of being behind di ‘unknown gunmen’ wey dey cause insecurity for di country. VeryDarkMan make di allegation on Tuesday while im dey talk for di 2026 NBA Annual General Conference for Port Harcourt, Rivers State. E claim say military, immigration and customs officers fit dey behind some of di attacks, despite […]

todayAugust 26, 2026 15

OBODO NAIJA

Sultan Call For Stronger Community Policing To Fight Insecurity

By Olabisi Olatunji Sultan of Sokoto, Muhammad Sa’ad Abubakar, don call for stronger community policing as better way to tackle insecurity across Nigeria. Represented by Alhaji Adamu Lamido Sanusi on Wednesday for Kaduna, di Sultan say security agencies must work closely with local communities to stop crime. According to am, youths, imams and community leaders know dia areas well and fit help provide intelligence to fight banditry and kidnapping. Di […]

todayAugust 5, 2026 22

OBODO NAIJA

Makinde Call Mehn to Touch Light Oriire Kidnap

By: Yusuf Abuh Oyo State Govo, Seyi Makinde, don call for independent investigation into di abduction of children and teachers wey hapun for Ahoro-Esinle and Yawota communities for Oriire Local Gornment on May. Di govo tok dis one for statewide broadcast on Monday for Ibadan after dem hand over 46 children and teachers wey security operatives rescue from bandits. Makinde say international human rights and accountability bodies, including agencies under […]

todayJuly 14, 2026 13

Local

Oyo Govt: We Dey Work To Save Oriire Kidnap Victims

By: Yusuf Abuh Oyo State Government don promise say security pipo dey work well-well to save di school children and teachers wey bandits kidnap for inside Oriire Local Government since May 15. Di government tell di families say dem feel dia pain, and dem dey stand with dem as operation dey go on to bring di victims back safely. Reports show say di bad pipo carry dem go inside Old […]

todayJuly 6, 2026 25

OBODO NAIJA

Army Chief To Employ AI

By: Yusuf Abuh Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, don call on Nigeria say time don reach for us to use artificial intelligence (AI) and other new technology take fight di insecurity gbeges  for di country. E tok dis one during Nigerian Army Day Celebration lecture for Port Harcourt, say insecurity don pass terrorism and banditry enter cyber attacks, organised crime and other tech-driven threats. Shaibu say di […]

todayJuly 6, 2026 15

south west

Oyebanji Vow To Fight Kidnappers After Victims Regain Freedom

By: Yusuf Abuh Ekiti State Governor Biodun Oyebanji don visit di Eda-Oniyo worshippers wey kidnappers release afta dem spend more dan two months for captivity. Di govo see di survivors for Ekiti State University Teaching Hospital, wia dem dey receive treatment, and say sugar wan finish am as im see one small pikin regain consciousness. Oyebanji promise say na di state gornment go pay all di victims' medical bills. E […]

todayJuly 6, 2026 11

south west

Amotekun Rescue Kidnap Victim

Amotekun senior men officers  inside Ondo State don do james bond rescue one person wey kidnappers carry and dem arrest one papa join his three sons for Oba Akoko area. Di Amotekun Commander, Adetunji Adeleye, say dem catch di papa, Iliasu, and im pikins dem, say dem turn kidnapping to family business. Dis na after di victim papa report to dem. Dem catch di suspects with different things like drugs, […]

todayJune 30, 2026 16

OBODO NAIJA

President Tinubu Give Oyo Hope

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don assure pipo for Oyo State say, make dem nor too worry demselves say goment go rescue di pikins and dia teachers wey kidnappers carry from three primary schools for Oriire Local Government Area. Baba Seyi tok dis one for Ibadan for wia im go run one or two parrol. Im say security agencies dey use every possible way, including support from […]

todayJune 26, 2026 9

OBODO NAIJA

Femi Falana Advice FG To Give Naija Youth Work

By: Yusuf Abuh Human rights lawyer, Femi Falana, don drop beta bombshell say creating state police alone nor go fit solve Naija insecurity problem. According to di senior man lawyer, say, di tin nor go shake scale since poverty and unemployment strong. Falana yarn dis one for TV sit down tuk on Thursday, say plenty young pipo dey enta crime because of lack of work and no social support. You […]

todayJune 26, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds