By: Rilwan Agbomeji
Lagos State Govment, don join body with Federal Ministry of Works, don announce say dem go start repairs for failed asphalt parts of ramp and service lane wey connect Inner Marina to Apongbon Bridge, plus some parts of di bridge lanes.
State Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, tuk say di work go start for service lane on Thursday, February 5, and e dey expect say e go finish on Thursday, March 19, 2026.
E add say to make road users safe and make work smooth, some sections of di affected roads go close temporarily.
Motorists don dey advise to find alternative routes while repairs dey go on.