By: Rilwan Agbomeji
More than 100 people bin fear say don kpai for Tuesday night afta deadly attack wey Islamic militants carry enter Woro and Nuku communities for Kaiama Local Government Area of Kwara State.
Kwara State Govo, AbdulRahman AbdulRazaq, On Wednesday night later confirm say 75 people kpai for di gbege as e address residents for palace of Emir of Kaiama, say di victims na local Muslims wey dem kill because dem refuse follow extremists wey dey preach strange doctrine.
E still add say Presido Bola Ahmed Tinubu don approve immediate deployment of Army battalion to di area to start counter-offensive operation wey dem name Operation Savannah Shield.