By: Esther Ayoola
Cry cry never still dey stop afta di death of Nigerian footballer, Saburi Adeniji wey people sabi as Ola, afta e wife and small pikin reach UK just one day afta him pass away.
Adeniji wey be left winger for Kings Park Rangers Football Club for Sudbury, die on Friday morning afta e suffer serious brain stem injury.
According to di club, di 26-year-old try fight for im life but n r make and like dis dem arrange make him family travel from Naija.