By: Esther Ayoola
Lagos State Permanent Secretary and Solicitor General, Hameed Oyenuga, dey cry wetin nor good say Lagos dey smell eh, say Lagos dey smell, all because of pipo just dey troway dirty yangayanga everywhere.
E yan dis one for ogbonge two-day retreat wey Lagos State Special Offences Mobile Court hold for Amber Residence, Ikeja.
Dem title di retreat “Di Mandate of di Lagos State Special Offences Mobile Court, Strategies for diPath Ahead.”
Oyenuga use di opportunate wey im take tuk, beg everybodi oh, say im carry God and im wife take beg Lagosian, say make dem nor spoil Lagos environment.