LAGOS STATE GOVERNMENT

31 Results / Page 1 of 4

Background

Lagos

Sanwo-Olu Show New Team To Run Lagos Gorment

By : Shalom Ovie Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu don present Deputy Govo, Obafemi Hamzat and senior lady Princess Damilola James as di team wey go carry Lagos gofnorship ticket. Di govo tok for news statement say di pair get di experience, vision and capacity to continue di development wey Lagos don enjoy over di years. According to am, di ticket represent di strength, diversity and bright future of Lagos State. […]

todayJune 11, 2026 15

Lagos

Lagos Goment Carry 45 Beggars Commot For Oshodi, Agege And CMS

By : Jolayemi Olajide Lagos State Goment don carry 45 beggars, including grown-up pipo and pikin dem, commot from road during enforcement operation for Oshodi, Agege and CMS. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn dis tori for statement wey im post for im X page on Wednesday. According to am, dem arrest 22 beggars for Oshodi and Agege, and di people wey dem carry include adults and […]

todayJune 3, 2026 9

Lagos

Lagos Gornment Ban Heavy Load For Danfo

By: Esther Ayoola Lagos State gornment don announce ban on movement of goods and heavy luggage for danfo across di state. Na di Lagos Metropolitan Area Transport Authority dey tuk dis one for statement wey dia Head of Corporate Communication, Kolawole Ojelabi, release on Tuesday. Dem say di enforcement go start from June 1, 2026, and e go affect buses wey dey carry passengers for public transport system. Dem explain […]

todayMay 20, 2026 11

Lagos

Lagos Gorment Close Eko Bridge For Repairs, Give Traffic Alert

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment don announce emergency closure of di outbound lane of Eko Bridge for Lagos Island. According to Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, through statement wey dem wrap like moimoi, say di closure go start on Tuesday, May 12, 2026, for safety checks and repair work. E con sti add say, inward lane for Lagos Island go sti dey open for motorists to pass. Dem […]

todayMay 11, 2026 9

Lagos

Lagos Clarify Sanitation Rules, Warn Defaulters Before April 25 To Cleanup

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don announce say monthly environmental sanitation go start again on Saturday, April 25, 2026, with movement restriction for di state from 6:30am to 8:30am. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab,naim put dis one for news statement. Say di exercise na to allow residents clean dia houses, environment and drainages wella. According to Wahab, enforcement teams from LASPARK, LAWMA, KAI and other agencies […]

todayApril 22, 2026 28

Lagos

Lagos Gorment Giv Obalende Park To Developer To Make Am Fine

Lagos State Gornment don officially hand over Obalende Park give redevelopers to build di place. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, after im run di mata on Wednesday  say di project dey very important for di state development. According to Wahab, dis kind move go help improve how Lagos look and how people go take use public spaces.

todayApril 16, 2026 17

Lagos

Lagos Gorment Announce Road Diversion for Project Inauguration

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don announce say dem go close some main roads for parts of di state to allow commissioning of major projects on Wednesday and Thursday. Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, naim yarn dis one on Tuesday, say di temporary closures na for safety and to make sure di events run smoothly. On Wednesday, April 8, di Opebi-Mende Link Bridge go dey commissioned from 9 a.m. […]

todayApril 7, 2026 34

Lagos

Sanwo-Olu Free 43 Inmates As Lagos Dey Fight Overcrowding For Prisons

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don approve di release of 43 inmates from correctional centres across Lagos State on Monday, to hellep reduce overcrowding. Attorney-General and Commissioner for Justice, Lawal Pedro, say di release sef don show Gornment commitment to justice, fairness, and proper rehabilitation for inmates. Di inmates wey sti get prison sentence normally,  say dem carefully check dia character according to legal and administrative rules, […]

todayApril 7, 2026 15

Lagos

Lagos Begin Drag 45 People, Companies Go Court For Tax Wey Dem Owe

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don start to prosecute 45 pipo and companies wey dey owe tax of billions of naira. According to Attorney-General, Lawal Pedro (SAN) yarnings on Monday for Lagos, say dem don arraign di defendants for Lagos Revenue Court make dem pay di outstanding tax wey dem dey owe. Some of di pipo wey dem list na Chidi Ajaere Emmanuel wey owe N35.4 million, Ifeanyi Uzoaru […]

todayApril 7, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds