By: Rilwan Agbomeji
Spanish champions Barcelona don write official complaint give Royal Spanish Football Federation over wetin dem call inconsistent refereeing.
Di wahala start afta referee cancel one goal wey dem score for dia 4-0 Copa del Rey defeat against Atlético Madrid on Thursday.
Barca send letter go both RFEF and di referees committee, Comité Técnico de Árbitros, demand more transparency and better standard.
Dem talk say different decisions dey given for similar fouls, and say repeated referee mistakes dis season don affect di integrity of di competition and increase mistrust.