Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Oga CEO of Sports Facilities Construction Limited, Ebi Egbe, don raise alarm say NPFL need emergency help.
Say di league dey go ground every day following recent ranking by IFFHS say, di Naija league don fall enter 91st for world ranking.
Reacting to di post for X, Egbe say na because say, football ground don kpafuka finish, no good pitch, ni make we nor dey see good football.
Egbe use di opportunate take charge gornment to declare “state of emergency” to save Nigerian football, make pipo wey fit help, come help di league.
Written by: News Author
Nigeria Professional Football League Nigeria sports news Nigerian football crisis NPFL news
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026