OBODO NAIJA

First Lady Open Church For NASS, Say Make Lawmakers Sef Dey Go Church

todayMarch 2, 2026 3

Background
share close

Wife of Presido, Oluremi Tinubu, on Sunday for Abuja don do open National Assembly Christian Fellowship Chapel wey go contain, 750 people inside National Assembly complex.

For her tuk, tuk, Mama Oluremi package wetin nor good for di chapel, say na sign of accountability, remind lawmakers say every bodi go give account one, day, by one day, particularly those once wey dey bring law wey press pipo neck.

She sha pray for di chapel, encourage di leaders to humble and serve  Nigeria wella.

Representing wi oga presido  for the mata, Senate Presido, Godswill Akpabio, come tell Nigerians make dem no too focus on religion but choose leaders wey get capacity, love Nigeria and ready to bring prosperity and end insecurity.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app