Wi oga Presido, Bola Tinubu don clear wi Infrastructure Concession Regulatory Commission say make dem run di National Gas Infrastructure Command Centre (NGCC) as Public-Private Partnership (PPP) way, say gorment nor wan put serious money for di project.
DG of di commission, Dr Jobson Ewalefoh, na im dey conversate dis mata inside for dia first Project Steering Committee meeting.
NGCC na big national plan wey go monitor and manage Nigeria gas infrastructure in real-time, and private company go fund am fully.
Ewalefoh explain dat, dis instruction show say di President wan make private sector lead for infrastructure work and dat e go hellep save public money.