Lagos

NDLEA Gbab Former-Lagos Councillor With 40kg Skunk For Ibeju-Lekki

todayMarch 9, 2026

Background
share close

By: Esther Ayoola

Naija Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, operatives don go gbab one former councillor for Lagos State, Sadiq Olalekan, for drug mata.

Tuk, tuk of NDLEA, Femi Babafemi, Say dem pick di 45-year-old man for im house for Ilado area of Ibeju-Lekki afta dem receive correct intelligence informate.

According to di NDLEA tuk tuk person, when officers search di house, dem see about 40 kilograms of skunk wey be strong type of cannabis, say dem bin  hide am for one room.

During questioning, Olalekan agree say di drugs na im own and say na im get di house, as he also konfam say e don serve two terms before as councillor for Orimedu community.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app