By: Esther Ayoola
Ikorodu City don shock everybody as dem beat Rivers United 1-0 for Mobolaji Johnson Arena, Lagos, on Monday.
First half no goal, but both teams try score sha.
Rivers United wey everybody dey reason say dem go win di league no fit break Ikorodu defence.
Na For di 52nd minute, substitute Folarin Temitope score from rebound wey goalkeeper Rashid Owolabi no fit hold after Salami Farouk try shot, ni settle di tie.