By: Esther Ayoola
Oyo State Police Command don re-arrest one suspected kidnapper wey escape from police hand before.
According to police tuk tuk, DSP Ayanlade Olayinka on Wednesday, di Police catch di man, Ayomide Kareem, 25 from Osorun’s Compound, Oyo, for Irepo Junction, Ojongbodu, around during one routine stop-and-search patrol.
Dem stop am because e dey waka suspicious, and wia dem con see say  na di same person wey escape from Jobele Division custody on March 10 over suspected kidnapping case, staright up na so dem gbab back to station.