U.S and Iran dey yarn different tori about, if dem go fit talk over di war.
Presido, Donald Trump say, e stop im plan to attack Iran power plant after e get “productive” gist with Tehran.
But Iran parliament oga tuk say no tuk don happen, e call am “fake news.”
Nor forget say IRAN bin threaten to close di full strait of Hormuz, if US try nonsense with di power plant.
However, One Iran foreign ministry person talk say dem don dey get small signal from US through people wey dey mediate, so tuk fit start from dia.