Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Fight against drug trafficking don gain weight as National Drug Law Enforcement Agency and Nigeria Customs Service join bodi together for Kirikiri Lighter Terminal for Lagos on Wednesday.
New NDLEA Tincan Strategic Commander, Solomon Gbadebo Omotosho, na im lead delegation go visit Customs command to strengthen cooperation.
Acting Customs Area Controller, Bolaji Lukman Adigun, say di partnership go help secure ports better and balance enforcement with smooth trade.
Dem say di move necessary because drug traffickers dey use Nigerian ports take run illegal business, so both agencies wan block all loopholes.
Written by: Ridwan Agbomeji
CRIME custom DRUG TRAFFICKING NDLEA
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026