By: Esther Ayoola
Lagos State Commissioner of Police, Fatai Tijani don drop promise say gone are those days wey pipo go dey fear police, say like dis na collabo doings di police dey do.
Di new commissioner yan dis on Friday for command headquarters for Lagos ahead of 2026 Police Week wey go start on Monday.
According to am, modern policing need cooperation, respect and trust, and na why dem dey use community policing take connect with pipo.
Im come add say without public confidence, police no fit work well, so dem dey take different steps build and sustain trust with di community.