By: Esther Ayoola
CAF Presido, Patrice Motsepe, say like dis now, say dem wan increase di Africa Cup of Nations teams from 24 to 28 wey go dey play di AFCON.
E tuk dis one for press conference on Sunday afta CAF executive committee meeting for Africa, say di change na to turn Africa football to  world-class football.
Motsepe nor explain how di tournament go fit take di extra four teams or when di new format go start.
Before now, di last four editions get 24 teams, afta dem increase am from 16 teams for 2019.