In response, INEC say dem nor go accept any jaguda doings to force Chairmo, Prof. Joash Amupitan, to resign.
INEC Chief Press Secretary, Adedayo Oketola, put for statement on Thursday, say demand for Amupitan resignation na attack on di Commission wey dey independent.
Di statement follow ADC call wey dey accuse INEC of favouring some political party and asking Amupitan to comot office.
INEC explain say di claim of bias nor get foundation, especially as dem just follow Court of Appeal ruling.