Ondo Speaker Explain Why Christians Need to Always Support Peace, Unity
Speaker of Ondo State House of Assembly, Olamide Oladiji, don tell Christians for im state say, make dem dey promote peace, unity and get patience.
E tuk dis one for im Easter message wey e give Christians for Akure on Sunday.
Oladiji encourage Christians make dem follow Jesus Christ example, try to  sacrifice, love and build beta togetherness.
E con wish dem happy Easter and pray make di joy wey Jesus resurrection bring continue to dey spread for di obodo Nigeria.