One dismissed Nigerian soldier Rotimi Olamilekan, don scatta table oh, wey people sabi as Soja Boi, explain how many army personnel dey suffer buy dia uniform and protective gear by demselves.
E yarn dis one for one interview wey never drop, as e tuk say im last salary before dem sack am na around ₦109,000 to ₦111,000, after dem increase am from about ₦51,000.
According to am, before di increment, even with allowance, di total money no pass ₦70,000, and life hard wella for soldiers.
E still complain say aside salary, nothing extra dey come, and buying uniform by themselves just make di suffering worse.