By: Esther Ayoola
Liverpool legend Jamie Carragher don scatta table again oh, say di club nor go get problem replacing Mohamed Salah wen Salah go comot by di end of 2025/26 season.
E tuk dis tuk for Liverpool website say plenty great players bin play for Anfield before Salah.
E explain say nobody dey for football, wey dem nor fit replace, even though say im na goal scorer.
Carragher believe say Liverpool go still fit scout new player to continue scoring di goals.