By: Esther Ayoola
Vice Presido, Kashim Shettima don promise again oh say make Nigerians nor too worry body about security, say very soon all di gbege go be tins of di past.
Oga Vice presido yarn dis one for di final day of di National Police Day parade for Abuja, saying dat reform plus unity go hellep push things forward.
Shettima make am clear say everybody gat support police and other security pipo, say na cooperation dey make rice dey full pot.
Im sti use di opportunity advice police leaders say make dem listen to citizens well and treat dem like partners to keep peace for di country.