Federal Government Nigeria

18 Results / Page 1 of 2

Background

Lagos

FG Promise To Upgrade Makoko, Gishiri, Other Ghetto Areas To Big Communities

By: Esther Ayoola Minister of Housing and Urban Development, Muttaqha Darma, don drop update say federal gornment  dey plan to turn informal settlements like Makoko for Lagos and Gishiri for Abuja into beta places to live. E tuk dis one when Naija Institute of Town Planners visit am for Abuja. Darma mention say areas for Kano and Port Harcourt sti dey among places wey need upgrade from ghetto condition. E […]

todayMay 19, 2026 8

National

Vice Presido Shettima Vow To Speed Law To Deliver Ogbonge Public Administration

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don assure, say Federal Gornment go reach out to important stakeholders make dem pass ogbonge amendment bill to change Naija administration wey dey before National Assembly. Say dis bill go change name of Institute of Chartered Secretaries and Administrators of Naija (ICSAN) to match modern governance level and also expand dia doings. Shettima tuk dis one when ICSAN delegation led by Presido and […]

todayMay 11, 2026 13

Lagos

FG Officially Hand Over New Carter Bridge Project To CCECC

By: Jolayemi Olajide Federal Gornment don officially hand over work to build new Carter Bridge for Lagos give China Civil Engineering Construction Corporation (CCECC). Di handover ceremony hapun for Carter Bridge, Lagos Island, on Wednesday as part of President Bola Tinubu plan to protect important infrastructure and keep Nigerians safe. According to Minister of Works, David Umahi, di move dey come after many years of investigation on di serious structural […]

todayMay 7, 2026 13

National

FG Begin Plans To Bring Citizens Home From South Africa Based On Xenophobia Gbege

By: Esther Ayoola Federal Gornment don start plan to evacuate Nigerians wey dey South Africa, based on xenophobic tension and protest. According to Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu, wey tuk dis mata on Sunday for her X page, baba Seyi don give order for Nigerians Safety first. Say na about 130 Nigerians don already register for voluntary repatriation flights. Dis evacuation dey happen because of rising protest wey pipo dey […]

todayMay 4, 2026 12

National

FG Raise Allowances, Ginger Civil Servants Welfare

By: Esther Ayoola Say like dis Naija Federal Gornment don approve increase allowances and oda welfare packages for civil servants, to boost dia living Head of Civil Service of the Federation, Didi Walson-Jack, naim yarn dis one on Friday for Abuja during press briefing, say Federal Executive Council don approve di reforms. She explain say di new arrangement go affect workers under CONPSS and CONRAISS salary structures, so e go […]

todayApril 24, 2026 9

National

FG Add Fresh Charges for El-Rufai Case, Say Im Tamper with National Infrastructure

By: Esther Ayoola Federal Gornment, through Department of State Services and dia lawyer Oluwole Aladedoye, on Thursday for Federal High Court Abuja,  don add new charges against former Kaduna governor Nasir El-Rufai. Say im interfere with critical national infrastructure and access classified information without approval. Dem file di korectted version of five-count charge on April 13, 2026, to replace di earlier three-count charge wey dem first bring come on February […]

todayApril 24, 2026 19

National

TUC Beg FG Make Dem Use Crude Money Help Refineries

By: Esther Ayoola Trade Union Congress of Naija don tell Federal Gornment say make dem use excess crude oil money support local refineries, so dat dem go sell fuel cheap for Nigerians. TUC President, Festus Osifo, tuk dis one for Abuja, say like dis now say, petrol fit reach N2,000 per litre, if gornment no act fast. Festus sti press tuk on why wi federal gorment need act fast, saying […]

todayApril 10, 2026 15

National

Shettima Drop Assurance Again Say Naija No Go Fail

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don promise again oh say make Nigerians nor too worry body about security, say very soon all di gbege go be tins of di past. Oga Vice presido yarn dis one for di final day of di National Police Day parade for Abuja, saying dat reform plus unity go hellep push things forward. Shettima make am clear say everybody gat support police and […]

todayApril 7, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds