National

Osun Assembly Call For Clean, Free Election For 2026

todayApril 10, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Osun House of Assembly don raise concern say make di governorship election wey go happen on August 15 dey free, fair and credible.

Dem tuk dis one afta INEC move dia Resident Electoral Commissioner, Mutiu Agboke, go Ondo State.

Speaker of di Assembly, Adewale Egbedun, say, whoever INEC go put for di state must follow Constitution and Electoral Act wella.

E sti tuk say di sudden change dey raise suspicion, but e get confidence say Osun pipo go protect dia vote and make am count.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app