By: Esther Ayoola
One Lagos lawmaker, Temitope Adewale, don open secrete tuk say Nigerians, especially councillors, suppose hold local gornment chairmen accountable for how dem dey run things and deliver service.
Im tuk am during interview with Newsmen on Sunday inside Lagos.
Adewale explain say Supreme Court judgment wey hapun for 2024 don give all Naija 774 local gornments financial autonomy, so dem go dey receive money direct from federal allocation.
E sti express worry say , im nor understand why many Nigerians dey sti blame Federal Gornment for problems wey dem suppose to face local gornment.