Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Joint Admissions and Matriculation Board don release result for candidates wey write 2026 Unified Tertiary Matriculation Examination on Thursday, April 16, as 632,788 results don dey ready to check.
For statement wey dem release Friday, spokesperson Fabian Benjamin tuk say make candidates send “UTMERESULT” go 55019 or 66019 with the same number wey dem use register take check their score.
JAMB talk say for now, na only to view result dey possible, as printing option never ready.
Dem still warn say anybody wey try to change or manipulate result message from official source dey commit serious offence wey fit land person for wahala.
Written by: News Author
2026 JAMB First Batch Resul JAMB Results JAMB Warning Nigeria Students Admission
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026