National

Retired Police Officers Protest We Nor Go Gree For Abuja Over Pension Scheme

todayApril 20, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Say some Retired police officers under Police Retired Officers Forum of Nigeria (PROF) on Monday block one gate for Presidential Villa for Abuja as dem protest against contributory pension scheme.

Dem dey protest say di Scheme for Naija Police Force dey illegal, bad and e dey cause suffering and early death for retirees.

Di group dey beg wi oga presido  Bola Tinubu, make e sign Police Exit Bill wey National Assembly pass on 4 December 2025 and send go Presidency on 16 March 2026.

Dem explain say if di bill become law, e go remove police from di pension system wey dem call “slavery scheme” and improve dia welfare.

 

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app