By: Esther Ayoola
Cuban gornment don konfamat on Monday for Havana say, dem hold tuks with United States officials as tension sti dey between both countries over US energy and oil blockade for Cuba.
Deputy director general for US affairs for Cuba Foreign Ministry, Alejandro Garcia del Toro, naim dey konfam dis mata say US delegation include assistant secretaries of state, while Cuba side send deputy foreign minister level pipo come di meeting.
E explain say di tuks hapun with respect and professionalism, and US side no give any threats or deadlines like some US media reports bin claim.
He add say di main reason for di meeting na to push make US end di oil blockade wey dem call top priority for Cuba, while dem also accuse Washington say dem dey use blackmail against countries wey dey export oil go Cuba.