UNITED STATES

21 Results / Page 1 of 3

Background

obodo oyinbo

Iran Knack Chest Say Dem Ready To Face Fresh US Sanctions

Iran don talk say e ready to withstand di wider sanctions wey United States announce to isolate di country from di global economy. Iranian Economy Minister Ali Madanizadeh say Tehran fully prepared for di measures and believe say dem go lead to another defeat for America. US Treasury Secretary Scott Bessent say any country, bank or business wey continue financial dealings with Iran go face isolation if dem refuse to […]

todayAugust 25, 2026 8 3

National

Iran Set Conditions For Opening Strait Of Hormuz, Demands US Action

By: Kofoworola Olayinka Iran top negotiator Mohammad Bagher Ghalibaf don say di country no go open di strategic Strait of Hormuz until United States meet dia demands. Ghalibaf talk on Tuesday say America must remove di naval blockade, lift oil sanctions and unfreeze Iran money wey dey abroad before di strait fit reopen. E say di demands dey inside di Iran-US truce wey dem a

todayAugust 19, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Deny US Weapon Shortage, Threaten Leakers with Jail

By: Esther Daniel US Presido Donald Trump on Thursday deny reports say America weapon stock don finish after military operations linked to Iran, insist say di kountry still get plenty munitions and factories dey produce more. Trump, for im Truth Social post, say fresh weapons dey continue arrive as needed and defence companies dey expand production across di United States. Di US Presido accuse people wey leak di reports of […]

todayAugust 6, 2026 16 2

obodo oyinbo

Middle East War, Iran, US Near Peace Deal

By: Esther Daniel Iran don yarn say dia agreement with Oman to reopen Strait of Hormuz don nearly set finish after both countries agree on di route wey ships go dey follow. US Presido Donald Trump still dey tok say America and Iran dey discuss matter, and im say e prefer make dem settle am with dialogue instead of war. For anoda side, Yemen Houthis claim say dem attack two […]

todayAugust 6, 2026 11

obodo oyinbo

US Don Vex! Blow Hot for Kaduna Massacre, Tell Tinubu “E Don Do!”

By : Jolayemi Olajide Di United States don strongly condemn di early morning attack wey happen on July 27 for one village in Kaduna State, where reports say at least 30 people, including children, lose dia lives after gunmen attack di community. For statement wey di US Bureau of African Affairs post on X, Washington tok say e dey deeply sorry for di families of di victims and condemn di […]

todayAugust 1, 2026 12

obodo oyinbo

Netanyahu, Trump Meet Again As Iran War Tension Shake Their Relationship

By: Esther Daniel Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu go meet US President Donald Trump for talks at di White House on Tuesday, as both leaders try to manage issues from di Iran war wey don cause disagreement between dem. Di meeting go be dia first face-to-face discussion since di war with Iran started, as both leaders dey look for way to handle di situation. Relations between Netanyahu and Trump don […]

todayJuly 28, 2026 22

obodo oyinbo

Trump Yarn Say Iran Money Go Pay for Hormuz Ship Gbege

United States Presido, Donald Trump don tok say any damage wey happen to ships and cargo for Strait of Hormuz ehnnn, na frozen Iran money go pay for am. For post wey e make on Truth Social on Thursday, Trump tok say na Iranian money wey America hold go take settle any damage. Trump still tok say America don carry out 13 nights of strikes on Iran, and say e […]

todayJuly 24, 2026 12

obodo oyinbo

Iran Warn America: “Touch Hormuz Again, We Go Hit Back”

By : Jolayemi Olajide Iran on Thursday warn say Strait of Hormuz no be something to bargain with, saying if America increase military attack, dem go strike important facilities across Gulf region. Di warning come after five straight nights of US military operations and fresh naval blockade around Iranian ports, following Iran decision to close Strait of Hormuz last Saturday. Iran top official, Mohammad Baqer Qalibaf, describe di fight with […]

todayJuly 16, 2026 11

obodo oyinbo

US Dash Saudi $1.96bn Weapon Package

United States don approve $1.96 billion weapon package giv Saudi Arabia on Wednesday, make e boost im air defence, as war for Middle East dey become more serious. For inside statement, di US State Department talk say di $1.96 billion weapon package no be just to arm Saudi, but to make am one of America strongest padi for di Gulf region. Dis move come as Iran-backed Houthi fighters fire missiles […]

todayJuly 16, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds