obodo oyinbo

Gunman Kpai Tourist, Injure Six For Mexico

todayApril 21, 2026 5 2

Background
share close

For Mexico, say one gunman open fire for Teotihuacan archaeological site for central Mexico, kpai one Canadian tourist and wound six other pipo, including visitors for Pyramid of di Moon area.

Security official tuk say afta di attack, di gunman sti take im own life for di same site wey di tourists dey climb  to see ancient pyramids.

Authorities confirm say di wounded victims, dem don carry dem go hospital, including one Canadian woman, one Colombian woman and her pikin, one Brazilian, plus two Americans.

Dem sti dey investigate di reason behind di attack for di heavily visited tourist destination wey dey known for pre-Aztec pyramids.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app