By: Esther Ayoola
NCDC don tuk say make pipo nor panic afta dem confirm new COVID-19 case for Cross River State, say no sign of widespread spread for now.
According to NCDC DG, Dr Jide Idris, dem say all di persons wey come in contact with di patient dey under monitoring and dem dey track dem properly.
Cross River State Health Commissioner, Dr Henry Ayuk, explain say di case na Chinese man wey work for Akamkpa LGA and wey bin come Naija for work on March 17, naim show di symptoms.
Health authorities say dem don dey manage di situation to prevent any further spread and protect public health for di state.