By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don announce say monthly environmental sanitation go start again on Saturday, April 25, 2026, with movement restriction for di state from 6:30am to 8:30am.
Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab,naim put dis one for news statement.
Say di exercise na to allow residents clean dia houses, environment and drainages wella.
According to Wahab, enforcement teams from LASPARK, LAWMA, KAI and other agencies go dey ground to carry out inspection to make sure pipo comply.
Dem warn say anybody wey no obey go face punishment under Lagos environmental law of 2017.