By: Esther Ayoola
Police for Ondo State police command don do Rambo arrest one 29-year-old man, Awomehinde Tope, for Ile-Oluji area after allegation say im go thief im papa property.
Police tuk, tuk person, Abayomi Jimoh, naim dey convasate dis mata say di reason for di arrest be say, di suspect allegedly carry away tins like motorcycles, goats, palm oil, phones, gas cylinders, gold items and rugs from im father.
Jimoh sti explain say as police dey investigate, dem discover say one of di rugs im don already sell am to another person.
Na during di search for Ile-Oluji, dem find some items wey dem suspect say be human bones, say like di police investigation sti dey go on.